Rema di Afrobeats star wey neva ready to calm down, list of MTV EMA 2023 winners

Nigerian Afrobeats star Rema dey conquer di world wit im latest milestone wen im perform for football legends for di Ballon D’Or awards.

Dis dey come some days afta im make history wit im song Calm Down, wey become di longest-charting and most successful African song of all time for di Billboard Hot 100 for US.

Di 23-year-old appear to dey ride on di wave of unstoppable success of im musical career.

Rema, Nigeria Afrobeats singer

Rema latest achievement don add to di list of achievments wey plenti African acts don get on di world front wey include:

Burna Boy win Grammy award for 2021.


Ckay Love Nwantiti na di most Shazamed song across di world for 2021.
Jerusalema by Master KG and Nomcebo Zikode inspire pipo around di world make dem post videos as dem dey dance during di Covid pandemic.

Rema, unlike some of im Afrobeats artists, dey mindful of im place for di African music industry, and im debt to di pipo wey build di foundation so im go reach global stardom so fast.

End of Recommended articles

For example, e go perform for London’s O2 Arena on 14 November – di venue wit 20,000 capacity – just four years afta im start im musical career. But dis take Wizkid and Burna Boy ten years to achieve.

For September, during di MTV’s Video Music Awards ceremony, wen im collect di Best Afrobeats prize, Rema dey gracious wit im speech.

Afta im thank im fans, co-star for Calm Down; Selena Gomez and im team, im also greet some ogbonge Nigerian artists:

“E mean so much as I dey see Afrobeats dey grow big and I dey for dis stage dey represent Afrobeats dis night, I dey happy.

“But one tin I no go not forget dis night na to greet pipo wey open di door for me. Big shout-out to Fela who wey start Afrobeats.

“2Baba, Don Jazzy, D’Banj, D’Prince, Runtown, Timaya, 2Face, Wizkid, Burna Boy, Davido. And I wan to also salute di new generation of Afrobeats. We dey here to take am to di rest of di world.”

On Sunday, e bin win di Best Afrobeats Awards for di MTV EMA awards wey suppose happun for Paris.

Dis go be di first time di Afrobeats category go dey added to di European Music Awards.

Rema and Selina Gomez

WIA DIS FOTO COME FROM,REUTERS

Wetin we call dis foto,Rema and Selina Gomez